Home » Switzerland vs Germany: Euro 2024 live updates – BBC News Pidgin

Switzerland vs Germany: Euro 2024 live updates – BBC News Pidgin

Switzerland vs Germany: Euro 2024 live updates – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, Getty Images

Germany boss Julian Nagelsmann don dismiss suggestions say im side no go wan beat Switzerland on Sunday so dat dem go avoid Spain for di Euro 2024 quarter-finals.

Germany don already qualify for di knockout stage afta dem win dia opening two games.

Dem dey also top Group A wey mean say if dem beat Switzerland, dem go likely play Spain, wey don also win two of dia games so far and dem dey likely to win Group C.

“At di end of di day, e dey difficult to tok to your team and tell dem to lose,” im tok.

“E no make sense for competitive pipo. Normally you play a football game to win and dis game we go play am to win.”

Nagelsmann say Switzerland – wey dey second for di group wit four points, two points less dan Germany na “probably di best opponent” wey dem go face for di group stage.

“Di match go dey interesting – and we want to win,” im tok.

Germany bin win 5-1 against Scotland and 2-0 against Hungary so far, while Switzerland beat Hungary 3-1 bifor dem draw 1-1 wit Scotland.

Meanwhile, Switzerland boss Murat Yakin say im side no go too face pressure on Sunday sake of dia good performances so far – but dem still wan “give Germany tough time”.

“We bin get positive results for di first two games, and see wia we dey now, a good situation. We no need to win tomorrow,” im tok.

“First and foremost, we want to produce beta performance.”

Switzerland must win if dem want to stop Germany from topping di group, but dem dey in a good position to progress to di last 16 no mata how di result be.

Dem go fit only overtake dem from dia second position if Scotland win and Switzerland lose – and na six-goal gap dey for goal difference.

Di four best third-placed sides go also qualify for di knockouts and no team don ever fail to qualify from dia group afta securing four points for a 24-team Euros.

Team news

Nagelsmann – wey neva change im starting line-up for di Euro 2024 say im no dey plan to rotate im team.

Dis na to avoid risking or losing players to suspension despite di fact say dem don already qualify for di last 16.

Yakin say every Switzerland player dey available for di match in Frankfurt.

Match stats

Switzerland neva lose any match for dia past three matches against Germany. Dem win 1 draw 2.

Di three matches produce 16 goals, an average of 5.3 per game. Di Swiss bin don lose 16 of dia previous 18 matches against di Germans.

Switzerland neva lose dia final group stage game for any of dia past eight appearances for a major international tournament. Dem win 5 lose 3. Dia last na for Euro 2004 (1-3 vs France).

Switzerland don lose just one of dia past 12 games for European Championships – and na 3-0 loss to Italy for Euro 2020 – but since Euro 2016, di Swiss don draw more games for di competition dan any oda side (W4 D7).

Only Portugal Cristiano Ronaldo don score for more major international tournaments dan Switzerland forward Xherdan Shaqiri, wey don score for each of di past six tournaments since and including di 2014 World Cup (Euro 2016, 2018 World Cup, Euro 2020, 2022 World Cup, Euro 2024).

Jamal Musiala dey aim to become di first German player to score for each of im nation opening three games for major tournament since Miroslav Klose for di 2002 World Cup and di first ever to do so for di European Championship.

Im go dey 21 years and 118 days on Sunday, im go be di second youngest player ever to do so for any nation behind only Peru Teofilo Cubillas wey dey 21years and 94 days for di 1970 World Cup.